Dr Stella Immanuel doctor: Houston Texas Physician family in Cameroon wash hand off hydrochloroquine video deleted by Facebook, Twitter and YouTube

  • Leocadia Bongben
  • BBC News Pidgin, Cameroon
Dr Stella Immanuel covid

Wia dis foto come from, ScREENSHOT/TWITTER

Dr Stella Immanuel family in Cameroon for west central Africa don wash hand komot for her e tok say e di treat Covid-19 patients for America with hydrochloroquine.

On Tuesday video of Houston Texas family physician go viral before Facebook, Twitter, Youtube and oda platforms komot'am as Dr. Stella di tok for American pipo for for treat patients afta e treat 350 with hydrochloroquine.

One of Dr. Stella family mimba, weh e don reach 40 years, nurse for California-America for over 10 years, say e no di support e sista for dis mata.

De family mimba (weh e no wan make we call e name) tell BBC News Pidgin say deh no wan chuck mop for dis mata as anti Trump supporters don di attack dem.

Cameroonians di doubt Dr. Stella, as deh say e no di work for ICU, e no bi frontline worker, and di work na for family clinic.

Odas di wanda how e transform from pikin dia doctor sotei di treat na old pipo. Some say deh suppose admit e for hospital for mad pipo, say wit de kana tok for social media how e no care for black live mata.

Dr Stella Immanuel doctor school in CPC Bali

Wia dis foto come from, CPC Bali

Wetin we call dis foto,

Dr Stella Immanuel doctor school in CPC Bali

Dr, Stella Gwandiku, na pikin for Bali, Northwest Cameroon weh e go school for Cameroon Protestant College, CPC Bali.

But for seka Anglophone crisis, deh lock down de school and phone no di pass.

Bali village pipo say deh know de family name, but, since dia pipo get de habit for just migrate wit de whole family, e hard for tok for get e relatives.

"You know say Dr. Stella don bi America for more dan 20 years", Bouma tell BBC News pidgin.

Stella Gwandiku bi based for Texas-America get two pikin.